This podcast discusses the tragic death of 16-year-old footballer Ransford Owusu Ansah in Ghana. Allegations of sexual abuse by his coach, Ibrahim Anyass, led to a public outcry and the #JusticeForRansford campaign. Social media pressure forced police to arrest the coach, highlighting systemic failures in child protection and the power of public activism.
Justic for Ransford: Ghana Police arrest coach Ibrahim Anyass over death of academy footballer - BBC News Pidgin
Read original at BBC →#JusticeForRansford campaign start for Ghana afta death of academy player sake of alleged sexual abuse by coachWia dis foto come from, SIANOBAAKOPEWetin we call dis foto, Di 16-year-old boy dey di football academy for three years bifor he die Author, Komla AdomRole, Senior Journalist, BBC Pidgin8 November 2025, 09:52 WATNew Informate 6 hours wey don passDis tori get wetin fit turn your belle.
#JusticeForRansford dey trend for Ghana for several days.For social media, celebrities, influencers and oda citizens carry dia voice join dis hashtag to demand justice for one 16-year-old boy wey die in March dis year.Di juvenile footballer wey im parents carry am go di Siano Football Academy for Pokuase to become professional soccer star, allegedly suffer sexual abuse from im coach.
According to di late Ransford Owusu Ansah, di coach Ibrahim Anyass allegedly sodomize am almost evri day for three months inside di football academy.Afta di mother suffer to take care of di medical bills of di boy wen e fall sick, carry di mata go one local radio station, Oyerepa FM.Di little boy explain on top di radio show say "di coach always carry me enta one of di academy rooms wey e dey sleep wit me.
He say make I no tell anybody.""I get big wound but di coach still dey sleep wit me," di late Ransford tok for di radio show.E also explain say di coach promise to make am di best footballer if e allow am to kontinu to sleep wit am.Mother of di late juvenile footballer say di coach neva allow her to tok to her son on phone for many weeks even though Ransford tok am say e dey sick.
According to Eno Ansah, coach Ibrahim Anyass always dey tok am say di academy dey take care of her son and im hospital bills so make she no worry, until she go di academy by herself one day."Afta I carry my son come house, di condition become worse wey dem admit am for one children's hospital for Kumasi, bifor e enta coma for one month."
She tok di host of di Oyerepa FM show say "my son open up to wen im health become critical, wey dem admit am for hospital.""While e dey on admission I call di coach to give am update about di condition wey e send me money to pay for medical bills and buy herbal medicine. Di coach also promise to visit di child for hospital but e neva show up," Eno Ansah tok.
Ransford Ansah later enta coma for one month wey e get plenty bed sores bifor e die in March, according to im mother.She later report di mata to di police, but afta many months, dem no give am any closure wey she carry di mata enta social media.Inside one viral video, Eno Ansah cry out to Ghanaians say make dem help her get justice for her son.
Wetin coach Ibrahim Anyass tok about di allegationsDem call coach Ibrahim Anyass on top di radio show for his side of di story but e deny."Wetin Ransford tok say I dey sexually abuse am no be true. Dem carry Ransford come di academy wen e be small boy wey I train am till now. I no fit do such a tin to im."
Coach Anyass explain say "for some time, Ransford dey fall sick for di academic plenty times, wey I dey buy herbal medicine for am until di sickness become serious."Even afta dem play back di voice of di little boy wen e dey explain how di coach dey abuse am every day, oga Ibrahim Anyass still deny di allegation.
Wia dis foto come from, CHANGE.ORGWetin we call dis foto, Many celebrities and influencers add dia voice to di hashtag JusticeForRansfordMinistry of gender and social protection reactOne online petition wey dey demand justice for di late 16-year-old juvenile footballer get more dan 2,900 signatures as at 5 AM (GMT), Saturday 8 November 2025.
Di petition dey demand investigation into di mata from di Ghana football association, di Ghana police service and oda agencies to prosecute di coach.Gifty Saah Osei wey start di petition say, "absence of action from di agencies wey dey responsible be unacceptable.""Dis case dey expose weakness in di kontris child protection system, when adults wey dey in position of trust neva dey face any punishment, e dey teach oda predators say dem fit continue dia bad tins."
Inside one statement, di ministry of gender, children and social protection explain wetin do since di mata reach dia office.According to di ministry, dem find say di late Ransford Owusu Ansah dey di Siano Football Academy for Amasaman for three years, where his coach allegedly sexually abuse him."According to di records, di victim dey receive treatment since December 2024, bifor dem later admit am for di Komfo Anokye Teaching hospital (Kath) where he later die."
Di ministry tok say "management of di Siano football academy suspend di coach wey dem tok say dem go dey available to assist di law enforcement agencies to provide justice for di 16-year-old.""When di gender minister Dr Agnes Naa Momo Lartey take her post in February 2025, she engage di Ghana football association about dis mata to ensure accountability and strong child protection for di football sector."
Di ministry say "in addition to di suspension of coach Ibrahim Anyass, dem also close di football academy for investigations into di mata."Di domestic violence and victim support unit of di police (Dovvsu) chook eye for di mata wey dem transfer di docket to di homicide unit of di CID for further investigations.
Police tok anytin about di case?Di Ghana police service no officially tok anytin yet but sources say dem invite di suspect – Ibrahim Anyass to answer some questions for di CID headquarters.According to human rights advocate and lawyer for mother of di late 16-year-old, di police arrest di suspect."I fit tok you people say di police arrest Siano football academy coach Ibrahim in connection wit di Ransford case," lawyer Annan tok."
Dem dey investigate – sake of di law say pesin dey innocent until court go prove say you be guilty. As lawyer, we provide all di information to di police wit di help of Ransford family."E also explain say wetin remain now be for di police to submit di docket for dis mata to di Attorney General office for advice about how dis mata go continue.
Now pressure dey on di police to provide update on dis mata as di #JusticeForRansford campaign dey continu for social media.Popular blogger and digital journalist Kobby Kyei write for twitter (X) "dem take di life of dis young footballer afta years of abuse. No boy gatz to ensure sometin like dis. We stand wit di family and demand justice; boys deserve safety."
TV personality Anita Akua Akuffo also tok say "no human, especially a 16-year-old, deserve to die like dis. Di tin make I weak."Actor Yaw Dabo wey also get soccer academy say make di whole kontri rise to demand justice."I dey call on di president and oda big pipo like di IGP and odas to take dis mata serious.
Dis be shame to di Ghana football sector. #JusticeForRansford"For TikTok, pipo dey do videos to add dia voice to di call for #JusticeForRansford




